20-year old Stefano Tsitsipas from Greece don knock out defending champion from Switzerland Roger Federer from dis year Australia Open Tennis tournament wey dey happun for Melbourne.
14th seed Tsitsipas make di biggest win of im career to beat Federer 6-7 7-6 7-5 7-6 to progress to im first grand slam quarter finals.
Federer, wey be six-time champion, faile to reach di last eight for Melbourne only for di second time in 16 years.
Federer bin dey hope to win im third straight Australian Open title in a row for Melbourne before Tsitsipas end dat dream for am.
Di Greek save all 12 of 37-year-old Federer break points on im way to di famous win.
After di game, Tsitsipas say "im be di happiest man on earth".
"I no fit describe am, I beat my idol, ,my idol today become my rival." Na so Tsitsipas tok.Di moment Tsitsipas win, im drop im racquet dey celebrate wit shock as e cover im mouth start to dey cry before e waka go celebrate wih im team.
"I no go ever fit forget dat moment, dis match point go stay with me I believe for di rest of my life." Na so im tok.
Tsitsipas go play Spain Roberto Bautista Agut, who beat Croatian sixth seed Marin Cilic inside five sets, for di last eight, and im believe say e dey on di road to something very big.
" Dat na why I dey here, to play to win di trophy, I want am badly.2 Na so Tsitsitpas tok.
Wen Federer bin play im first professional tennis match, dem neva even born Tsitsipas wey regard di Swiss as "im idol."
Source: bbc.com
BDST: 1155 HRS, JAN 21, 2019
SMS